Church Gists

Anglican Pastors Vs Multiple Wives And Abortions

Published

on

Bishop Erifeta
Advertisements

PIDGIN ENGLISH NEWS

From Donald Ofuofo

The news wen dey blow follow everywhere for Mosogar now na very funny news as Ven. Sylvester Obukadata wen be former Rev Father for Roman Catholic church for Lagos state and wey change enter Anglican Reverend wen he see say him nor go fit continue with Catholic Church pattern because say as a Reverend Father him nor go fit marry and raise him own children as a Catholic Priest.

Na when dem create Sapele Diocese Anglican Communion nai him beg the Bishop of Sapele Diocese Anglican Communion say him don tire for Catholic as him get lover wen him get affair with not knowing say him don even pregnate the lady for Lagos, as Bishop Blessing A. Erifeta give am the go ahead and welcome am to Anglican Family from Roman Catholic family na once nai he carry people go do marriage for Lagos for the lady wen dey pregnant with him.pikin wen him be catholic priest. Presently he don get children with the wife.

When dem transfer this Rev go Otefe for Oghara nai him give one lady belle nai dem beg the babe to abort the pregnancy with some huge amount of money the girl say she nor fit kill her pikin, when the babe give birth na so this Man of God buy full 18 seater bus of baby things dat year go give the babe, till date na him dey take care of the child.

ALSO READ: Delta Clarifies Airport Concession, Approves Construction Of More Roads

Because say Anglican Priest nor dey marry two wives na so Bishop Erifeta vex for the guy as he send am out of the Diocese of Sapele dat time.

This Rev Sylvester Obukadata come go Warri go stay for some years before he come send people go beg Bishop Blessing Erifeta say make he forgive am say na temptation as dem lie for devil head. The Bishop wen him heart strong kokoroko come forgive this Rev Obukadata he come return am back to Sapele.

Presently another one don burst say this same Rev wen Bishop Blessing Erifeta promote to a higher rank as Venerable for Sapele Diocese dey commit fornication with one of him church member for Epiphany Anglican Church for Mosogar as dem dey settle the matter wen dem never even settle finish till now the Obukadata pass back go get another sexual affair with Helen wen be younger sister to the member wen him dey date wen dem still dey settle the matter and this time Helen don get Belle,

The reason why i put Bishop Blessing Erifeta for the update be say, The Bishop come send Venerable Ejuvwiekoko and other delegates go meet Helen Parents for Usienffrun for Warri side abi Ughelli area to go settle the matter on how dem go take compensate the family make dem for abort the Helen pregnancy. The family say make dem go bring #10m as dem later negotiate and agree for N500k after the delegates call Bishop Erifeta to tell am through phone wetin the family dey talk.

The family members don wait for Bishop Blessing Erifeta tire as dem never see him and the Venerable Sylvester Obukadata wen pregnate the Helen because as the belle dey grow dem say dem go carry the Helen come meet Bishop Erifeta make dem stay same house because The Venerable Obukadata dey on the run as dem nor use eyes see am again for Mosogar, Even the Vigilantes of Mosogar dey look for the Pastor wen he too like woman and nor dey rest as this one go make am, he number 3 gates after this girl don give birth.

Our Questions from studio be say.
Anglican priest dey get 2 wives?
Why Bishop Erifeta send other Reverends to go discuss Abortion matter and settle for N500k

If una know as youths don dey plan to change from Anglican, as some of deir parents dey vex say dem don stop church for the main time, till things normal again.

Una know say for many years na, problem boku for Sapele Diocese of Anglican Communion Wey make the members pursue their Bishop comot, some of the problem then be say the Bishop embezzle church money and other many crimes the church alleged against am.

At St John Anglican Church for Amukpe, the same Bishop take Soldiers beat many women Wey they protest Sey them no want the Bishop again. Na God save them from the hands of Erifeta. The people don carry so many protest in the past Sey the man of God must go. Even TV and papers carry all the news that time.

Members of Rescue team of the Sapele diocese, the women and the youths kpakpa stand gidigba Sey the Bishop must go. The elderly once Wey him dey course them too Sey him must not remain for the church.

All the members of the Diocese till today still remain in one voice Sey him must go not even after the former Primate Nicholas don intervene because according to them , them Sey no mater the situation, their Bishop no go change from all the allegations against am.

When our tori people visit the church few days back to interview them on the current position of the church, them Sey Bishop Erifeta must go na him them dey ooo as dem alleged Sey the new Primate never do the needful by chasing their former Oga away for peace to come back.

Each time our tori people call the Bishop make himself comment on the allegations against him, he no dey pick him call make him speak with these tori people but the man Wey say him bi the Bishop spoke man , ( otota) for urhobo language Mr Churchill Akure , say the Bishop no do all the things Wey the people been talk.

Facebook

Advertisements
Click to comment

Trending News

Exit mobile version